Ticker

56/recent/ticker-posts

Advertisement

BrightO, Wathoni, Tolanibaj evicted from BBNaija 2020 Lockdown show































Tolanibaj, Brighto and Wathoni don become di latest housemates to chop eviction from di Big Brother Naija reality show.

Ebuka put shock for di housemates body wen im ask Tolanibaj, Trikytee, Kiddwaya, Brighto, Prince, Erica, Lucy, Neo, Wathoni, Dorathy, Vee and Laycon to stand up.

Afta some wait wit tensions high, di show host come confam Tolanibaj, Wathoni and Brighto as di housemates wit di least votes, so dia for, dem gats leave di Big Brother House.

Tolanibaj wey be 27-years-old from Lagos State na media pesin wey bin serve as deputy Head of House wen Kiddwaya bin win di HOH challenge.

Florence Wathoni Ayansi na fashion entrepreneur wey dey 29-years-old and she be single mother. She say her plans now wey she don comot from di show na to continue wit her fashion business and "maybe start up TV show for pikin dem."

29-year-old Ezekiel Bright alias Brighto get plans to "get more certifications" as im see imself as career pesin.

How fans react to dia eviction

Viewers of di show no waste time to begin tok about how dem feel about di Sunday eviction.

For some of dem, dem feel say di eviction of wathoni come at di right time as she go reunite wit her son wey she don tok before say "she dey miss".

Skip Twitter post, 1

End of Twitter post, 1

Skip Twitter post, 2

End of Twitter post, 2

While for odas, dem feel say Wathoni eviction don clear road for Dorathy and Brighto strike up relationship.

Skip Twitter post, 3

End of Twitter post, 3

Skip Twitter post, 4

End of Twitter post, 4

Skip Twitter post, 5

End of Twitter post, 5

Dat whole expectation no last long as Ebuka change am for all di viewers wen im announce Brighto as di third housemate on di night to leave di show.


Dis announcement send fans into overdrive as dem bin no expect upto three pipo to go house inside one day.

Skip Twitter post, 6

End of Twitter post, 6

Skip Twitter post, 7

End of Twitter post, 7

Skip Twitter post, 8

End of Twitter post, 8

Skip Twitter post, 9

Watch Tolanibaj, Wathoni and Brighto all get evicted from BBNaija 2020 below





Post a Comment

0 Comments